APC National Chairman Adams Oshiomhole don chop suspension
Share Dis Tin With Email Share Dis Tin With Facebook Share Dis Tin With Twitter Share Dis Tin With Whatsapp
Adams Oshiomhole don be Govnor of Edo State before
Adams Oshiomhole, di national chairman of Nigeria ruling party don chop suspension from di Edo State chapter of di All Progressives Congress Party .
Di chairmen of APC, for 18 Local Goment Areas for di state pass vote of no confidence for Oga Oshiomhole on Tuesday, di State APC Chairman, Aslem Ojezu tell tori pipo.
Tori be say Osho baba and im state Govnor Godwin Obaseki dey get some kain quanta on top who dey in charge for di state.
“Oshiomole suspension na ‘beer parlour tok”
But Oshiomhole never tok for di mata and e neva dey clear how dis suspension for im local chapter go affect im post as National Chairman.
Image captionTori be say di former govnor of Edo state Adams Oshiomole and di present govnor Godwin Obaseki dey qwanta ontop di issue
Kasala burst since June wen nine out of 24 members sideline 15 odas to elect Speaker plus oda principal officers for Edo State House of Assembly inside di Southern Nigerian state.
We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.